Nov 01, 2024
Nigeria international passport application go contactless from 1st November - Wetin to know - BBC News Pidgin
Wia dis foto come from, Getty Images Di Nigeria Immigration Service, (NIS), don launch di ‘contactless passport application system’ on Friday 1 November, 2024. Dis new model go enable Nigerians to fit
Wia dis foto come from, Getty Images
Di Nigeria Immigration Service, (NIS), don launch di ‘contactless passport application system’ on Friday 1 November, 2024.
Dis new model go enable Nigerians to fit apply to renew dia international passport from di comfort of dia homes, and dem no go need visit any NIS office for capturing, finger print or anytin at all. Everytin go dey online.
Di agency wey announce di informate on dia X platform tok say, di contactless service go dey in phases, and di first phase go kick off for Canada on 1 November.
Phase two go start for UK, USA and Italy on 15 November, while Phase 3 go begin for Nigeria and di rest of di world for 1 December, 2024.
For im continued effort to serve di Nigerian public more efficiently and create functional standards wey meet global standards, di Nigeria Immigration Service (NIS) don launch one new contactless and issuance process wey go start from 1 November, 2024.
“Individuals go fit apply to renew dia international passports from di comfort of dia homes and dem no go need to visit any NIS office,” NIS tok for inside one video explainer on dia X account.”
However, dis new application platform na for passport renewal only, NIS stress.
Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Twitter post
Dis no be di first time wey di Nigeria Immigration Service dey announce dis informate.
For May, Nigeria Minister of Interior Olubunmi Tunji-Ojo bin tell BBC Pidgin for one exclusive interview say by 1 June, 2024 all tins being equal, Nigerians go fit get dia passport delivered to dem for dia house.
E bin tok say dem dey also work on reforms to make passport renewal process as contactless as possible.
"For courier delivery, all tins being equal, we dey look at starting dat by 1st of June, in terms of courier option and pipo go pay for di courier service, e no go be free.
“But di contactless process na for renewal purpose. Fresh applicants go need to go office for capturing and registration.
“For renewal, we dey look wetin dey happun for oda kontries, wia contactless biometric capturing dey happun, e tok.
Di minister as e resume office bin promise automation of di process to apply for passport for di kontri so dat pipo no go dey wait and suffer too long to get di green book as e bin dey happun in di past.
Before im assumption of office, to renew your passport for Nigeria fit take pesin months wit plenty stress but all dat stress don reduce now as di process don dey automated and waiting time don dey reduced to weeks.
But di minister say e no end dia.
"Realistically we dey target two weeks (to renew and get your passport) but for some places, e still dey take like three weeks but for me, wit di reforms wey we dey bring onboard in di next couple of weeks, even di two weeks go dey too long, so we dey look at one week." E bin tok.
NIS say Nigerians go fit renew dia passport by themselves by downloading di NIS mobile app on dia phone, once di app don dey available for dia region or dem fit apply on dia website.
Once dem download di app or visit dia website, make applicants follow all di steps wey dey outlined, and e include:
Di agency explain further say dem go process di application and deliver am to di address of di applicant.
You fit apply for Nigeria passport ontop di immigration website and di following na requirements for person wey wan apply for fresh passport, for adult and minor:
For Minors
Allow Twitter content?